Greetings to you all! Trust we are doing great? This topic I wanna treate ehn!, I got many cases that has happened to me back then, but I'll just talk about the recent one sha
Have you ever done something so embarrassing that you literally wished the ground would open and swallow you? Like, poof! Just disappear. My people, make I tell you wetin happen to me recently. If na film, e for be one of those ones wey person dey cover face dey watch. As e dey hot me that day, na so body dey pepper me. But anyhow sha, na life
So here’s how it all started
Last week, I attend one small birthday hangout my friend organize. Nothing too big just about 12 of us. Everybody dey vibe, music dey play low-low, people dey sip drink, gist dey go on. Then one of them just say, "Let’s play truth or dare
I should have just said I no want play, but you know how peer pressure be. I gree join. First round pass. Second round pass. Then e reach my turn. One guy wey like cruise just shout, “Dare!” before I even talk anything. Them say make I dance one-corner in front of everybody for 30 seconds

I think say I get mind, so I carry myself go center, begin dance. No be small energy I put oh. I even climb chair join. I no know say one small stone dey behind me as I wan come down. Before I know it gbam! I fall flat for ground
My dress fly up, my phone fall, everybody shout. The worst part? Someone record am. My pants even show small, and I dey wear that old one I for no even wear comot house
That moment, I just lay there for like 5 seconds. I no fit move. I wanted to vanish. I wan cry but I gats package small. I laugh join them like say no pain me. But deep inside, I swear I just dey beg God say, “Abeg just carry me now now
Since that day, I dey pray make that video no enter WhatsApp group. Up till now, anytime I see person wey dey there that day, na that shame go first rush me. Even my walking don change when I reach that area

But as I dey reason am now, I just dey laugh. Shame don turn to story. Na so we dey gather experience. I learn say not every dare is for me. I go dey think well before I gree join any party game again
So if you ever cringed so hard you feel like hiding for cave, no worry you no dey alone. Life go humble all of us one by one😂








